In most West African countries, pidgin English is a second language of its citizens. At times, this language combines both the native language of the people with the real English language. It is so simple that most people in such countries like Nigeria prefers to use it in business transactions, greetings, worship and in officiating ceremonies. Do you have someone whose wedding anniversary is coming up soon and you wish to make use of Pidgin English to write your anniversary wishes for him or her? Then, these wedding anniversary wishes in Pidgin English will help you in writing such.
Tell that your friend, colleague, sister or brother in that anniversary message in Pidgin, how you pray that good things will continue to happen them. Ask God to come and continue to be their guide and guardian in their Union.
Wedding Anniversary Wishes in Pidgin English
1. I dey happy sey Baba God don add another year to una Wedding. As Him take dey lead una on this journey, he no go make una know any pain. Him go dey provide everything wey una need, and na so so jolly jolly una marriage go be. Make una enjoy una anniversary celebration.
2. Una union dey make marriage dey hungry person. I dey pray make God wey put this kind happiness and joy in una marriage no leave una home. Nothing go fit scatter una marriage because Baba God go dey by una side everyday. Make una happy and scatter d dance floor on dis day.
3. As una add another year in una marriage today, anything wey go wan come scatter una marriage no go reach una house. Baba God go dey bless una dey go. Nothing go fit blow una light off. Make una enjoy, no shaking.
4. D love wey una get for each other no go minus, e go dey grow from strength to strength. Una go dey settle any wahala wey wan arise for una marriage in a beta way. I dey happy for una on dis day, make una break d bottles, I dey una back.
5. Person wey see una no go know say una don spend 10 years with each other. Husband and wife wey sabi well well, na wetin I dey call una. Make God dey watch over una home everytime so they evil people no go know una house address. Dis na the beginning, una go spend plenty years in a jolly way.
6. Anything wey una lay una hands on, go better for una. If e dey happen for front, una go dey for back. If e dey happen for back, una go dey for front. Anything wey go dey make una marriage sweet, una go dey get am in plentiful. Make dey love wey una get for each dey burn like fire wey person no fit quench.
7. I dey pray make e dey better for una as una dey old for una marriage. Na so so laughter people go dey hear for una house. I go still come follow una celebrate dis addition of another year, una be d best couple every year.
8. The person wey dey for d foundation of una marriage na Baba God, nobody fit put sand for una garri because una marriage dey protected. Una go get whatever una dey ask for as una come top another year for una wedding years.
9. Me I believe say God created both of una from d first day to be husband and wife. How una take love each other make me believe dis. I wan thank una for making other couples know say marriage dey sweet. Make una scatter d dance floor because na una get today.
10. D blessing wey God don use decorate una go dey increase everyday. When una call on Baba God, Him go come quick come answer una. Today na una day, make una do shakara.
11. Na so I dey shine teeth wen I dey read una wedding anniversary invitation card. I no get doubt for my mind say una union na made in heaven. Make better light dey shine for una ways. Make Una enjoy dis day.
12. Nothing fit make una sad as Baba God go continue seal una union with plenty blessings. Make every door wey una knock be opened for una. Plenty jolly jolly years ahead, naim I dey wish una.
13. As God take bless una marriage with all d things wey una need for this life, make Him continue to bless una with good health. Make una enjoy this day, my special people.
14. As una no spoil person own, nobody fit spoil una own. Na so so good news una go dey get. Una marriage go last forever. Better better days, na wetin I dey wish una.
15. Happy Anniversary to people wey dey help other people, Na only God fit reward una for all una dey do. Una pocket no go ever run dry.
16. Every year wey una dey spend for una marriage, na blessing on top blessings una go dey get. Happy Anniversary to my own people.
17. I dey envy as una carry love una sef. Wetin God don join together, nobody fit put asunder. Plenty better years ahead, I dey wish una.
18. My Oga, happy anniversary to you and your Iyawo. Make every road continue to dey clear for una.
19. Happy Anniversary my Paddy, make una union dey sweet like honey dey go.
20. Happy Anniversary my people, una go celebrate plenty anniversaries with good health plus prosperity.
Always try to celebrate with those who are close to you with these happy anniversary wishes in Pidgin English.
Also Read; Naija Romantic Pidgin Love Messages for Him or Her